Home / AFRICA / Nigeria police rescue girl wey parents lock am up for 10 years for Kano

Nigeria police rescue girl wey parents lock am up for 10 years for Kano

Authorities as dem go rescue weak Aisha jubril

A 15 year old wey parents lock up for 10 years don finally see rescue.

Nigerian police for northern state of Kano on Monday rescue Aisha Jubril wey dem keep for room since when she dey 5 years old.

Kano police command say dem receive report of di girl situation around 11am local time.

Di state commissioner of police immediately give order for officers to go rescue di girl.

Police say dem meet di girl without any proper feeding or needed healthcare living for dirty environment when dem go rescue her.

Presently di 15 year old dey Murtala Mohammed hospital dey receive treatment.

Meanwhile police don arrest di mother 35 year old Rabi Mohammed while di father currently dey on di run, according to police.

Last year Kano and oda northern Nigerian states witness a rise in dis kain cases wia guardians go lock up children.

But mostly na step mothers and oda relatives unlike dis case wey be say na biological parents of di girl.

Police say dem don hand over di case to dia criminal investigations unit and after dia investigations dem go send di culprits to court to face justice.

Source: bbc.com

About admin

Check Also

A visit to Nigeria is planned for Meghan Markle and Prince Harry in May, as the Duchess is rumoured to be avoiding a trip to the United Kingdom.

Meghan Markle and Prince Harry set to visit Nigeria in May as Duchess ‘plans to snub’ UK trip

A visit to Nigeria is planned for Meghan Markle and Prince Harry in May, as …

The Asantehene, Otumfuo Osei Tutu II, has underlined the spiritual guidance of the various religious bodies in the country as the source of his successful 25-year reign on the Golden Stool.

Religious support source of my success — Asantehene claims

The Asantehene, Otumfuo Osei Tutu II, has underlined the spiritual guidance of the various religious …