Home / AFRICA / NIGERIA: Kano state go punish food vendors pass people wey dey eat during Ramadan

NIGERIA: Kano state go punish food vendors pass people wey dey eat during Ramadan

 

Ramadan: Kano state go punish food sellers pass pipo wey dey chop during fasting

Kano State Hisbah Board say pipo wey dey sell food during di holy month of Ramadan fasting get more offence pass di pipo wey dey chop food for public during di period.

Hisbah Commander for Kumbotso local goment for Kano, north west Nigeria, Muhammad Gwani, tell BBC say food seller for di state even get offense pass pipo wey dey dodge fast.

“For our side, even though di pipo wey go buy food eat during fasting get offense di bigger offenders na di food sellers because if dem no sell di buyers no go come.”

Oga Gwani dey tok dis one afta three men and eight women chop arrest for Kano North West Nigeria for eating during fasting.

Officials of di Kano State Hisbah Board say dem bin arrest di eleven pipo as dem dey eat for broad day light meaning say dem no dey fast.

Di director general of di board Aliyu Musa Kibiya say: “we go torchlight di mata and if dem get beta reason we go release dem. Di ones wey dey guilty, we go teach dem and even cari dem go court if necessary.”

According to oga Gwani, di penalty dey different different based on wetin court tok but sometimes e no dey pass warning or flogging.

“For some of di offenders na just warning while di stubborn ones fit chop flogging based on wetin court order,” im tok.

For Islam, fasting during di month of Ramadan dey compulsory for all adults wey dey healthy.

Di only pipo wey dey exempted from fasting during dis period na pipo wey dey travel and women wey dey do dia menstruation.

Source: bbc.com

About admin

Check Also

Popular Nollywood actress Funke Akindele in a new video cries profusely after being accused of ignoring late actress Aderounmi Adejumoke.

I’m depressed, I also have my trying moment – Funke Akindele cries as she rubbishes neglect claims towards late Jumoke

Popular Nollywood actress Funke Akindele in a new video cries profusely after being accused of …

The sad and beautiful story of how Inaki helped raise Nico while their parents worked to make ends meet, as a Ghanaian parent who walked through the desert to get to Spain for greener pastures.

The Big Story: Inaki helped raise Nico while their parents worked to make ends meet

The sad and beautiful story of how Inaki helped raise Nico while their parents worked …