Kenya man wey confess to killing 10 children escape from Nairobi prison

One man wey confess to killing more dan 10 children for Kenya don escape from police cells for Nairobi.

Masten Wanjala suppose to appear in court on Wednesday over di murders of at least 14 boys for di capital, and areas of eastern and western Kenya.

Police say dem notice say e don disappear during di morning roll call.

Dem bin detain am during police investigations into di plenti tori child killings wey shock di nation.

Authorities don arrest three police officers wey dey on duty at di time of im escape from Jogoo Road police station, for di Eastlands area of Nairobi.

Authorities don launch hunt for di man wey dem describe as extremely dangerous.

Dem arrest Mr Wanjala for July and im confess to drugging and killing di young boys, as well as drinking dia blood in some cases.

Source: www.bbc.com

About admin

Check Also

Africa’s Future: Empowering Youth and Women, Achieving Financial Independence – John Mahama

President John Dramani Mahama has emphasized the need for Africa to empower its youth and …

Kenya eases travel requirements for nearly all African visitors

Kenya will allow citizens of nearly all African countries to visit without needing prior authorisation, …