Home / AFRICA / Rhodes memorial fire dey burn ‘out of control’ for South Africa

Rhodes memorial fire dey burn ‘out of control’ for South Africa

 

Di fire don burn part of one restaurant and for Rhodes Memorial and e still dey spread

Big fire wey dey out of control dey burn for Table Mountain for Cape Town, South Africa.

Fire fighters dey fight very hard to control di fire wey don go out of control as e don move begin burn buildings.

Di fire don burn part of one restaurant and for Rhodes Memorial and e still dey spread.

Unconfam tori be say di fire start afta one big explosion wey happun for di Rhodes Memorial restaurant. But no official statement yet on how di fire take start.

Di Cape Town Fire and Rescue Services tok tok pesin, Jermine Carelse, tell local tori pipo say dem bin get alert of di fire around 8:45am South African time.

Oga Carelse say dem immediately send firemen go di mountain side and dem still dey expect more fire-fighters to come join.

Im add say dem also get three helicopters wey dey water bomb di area – to try to quench di fire as dem dey use helicopter to release water from sky.

“Di fire currently dey out of control and we want make all di pipo wey geda to look make dem please no enta di area wey dem clea for emergency motr dem to pass,” Carelse tok.

 

Source: bbc.com

About admin

Check Also

The official opening of the Ukrainian Embassy in Accra was an attempt to strengthen diplomatic ties.

The Ukrainian Embassy in Accra officially opens

The official opening of the Ukrainian Embassy in Accra was an attempt to strengthen diplomatic …

Popular Nollywood actress Funke Akindele in a new video cries profusely after being accused of ignoring late actress Aderounmi Adejumoke.

I’m depressed, I also have my trying moment – Funke Akindele cries as she rubbishes neglect claims towards late Jumoke

Popular Nollywood actress Funke Akindele in a new video cries profusely after being accused of …